Sound Sultan - Area текст песни

Все тексты песен Sound Sultan

Yea, sound sultan, Naija ninja
Kennis, you know how we dey do am
This one na for all ma brothers who don go outside Naija
Who don ja commot for Naija
Always try to dey look back because there's no place like home
You know what I mean?
Yoruba man tell me say
Ajo o dabi ile
Na true
Check this out

Oh oh, yea yea

Bridge
Ajo o dabi ile
No matter where u go make u no forget area oh
Area oh
Na naija
Ti ode ba tile
Pada wale o
Wale o

Chorus
How I wish say I fit reach u anywhere u dey (u dey)
U dey (u dey)
Far away
That one no say make u dey bone area o
Motherland eo
Na your area o

Verse 1
Chinedu somebody borrow you go
Make you take travel go Chicago
Remember Nnamdi sell him car
So you go go America
All these people wey bin dey raise you
Still dey stay for face me I face you
Promise say u no go fashie them
Every other month u go dey tashi them
Hillary wey u bin promise to marry
Still dey wait, oh boy she don tarry
When she see u na inside Ovation
You marry Oyinbo from another nation
Use mago mago get dough
Now your Oyinbo wife don know
Next thing you know she don go report you
Wetin you know, them don deport you

Repeat Chorus

Repeat Bridge


Verse 2
You bin say na one year
E come turn to two years
You don go for seven years
But you dey serve eleven years
Even when your papa kpai
Plus the tears your mama cry
Bayo for Chicago o
Dem dey miss you for Okokoro o
Biodun for Canada
Your mama still dey wonder
Igba wo lo to ma pada o
Remember for Naija you get iyawo
Ko dabi ile (5x)
Ajo o ma dabi ile o

Repeat Chorus

Repeat Bridge

Verse 3
You say u go call
Everybody wait tire for your call
Rote o, why u go like so o?
From Germany, to carry coco enter Yankee
But then coco burst for your belle
Rest in peace
You fly away
How come one day wey fun dey u fit come back eo
Your papa land eo
I understand say u dey so far away
Long long way from home (4x)
You got a long long way from your papa land

Repeat Bridge

Think before u enter that plane
Sound Sultan, Naija Ninja
We doing it
All ma brothers in the west, south, east, north, south
U know how we doing it
And all these people wey dey rule us
Make una try make Naija sweet
So that people go dey come house
Make we get water, light etc
Kennis Music
Peace out

All the cardinal points
Respect ad lib
All ma people in da house

ДОБАВИТЬ ТЕКСТ В ЛИЧНЫЙ СПИСОК

Комментарии

Имя:
Сообщение: